If I want to recapitulate
From January to December
Many many things me ah no remember
Omo sapa choke me but I no surrender
Ahh
You know say kaki no be leather
But as e no kill me
It only made me stronger
I dey my tears and I
Raise my shoulder
I call my mummy make she no too sober
God's time I go make the money proper
Tell dem make dem free me
Shey if I get the money you go want to bill me
But if I dey suffer
You no even want to see
If I talk one you go want to contradict me
Why you dey cheat me
Only God fit to save us oh
Make judas no betray us oh
Make the sapa just dey chase us oh
No need their fake love oh
Dey go rip us like jacob oh
Dey go shame us oh
So we say
Away
Don't you ever come another day
Poverty away
Don't you ever come another day
So we say sapa away
Don't you ever come another day
Wahala away
Don't you ever come another day
If I wan dey recapitulate
January to December
Sapa come deadly for the matter
Rádà rádà show me shege
Regularly I remember
The fvck ups enough to fvck us
I no gree oh
Still dey shine all my teeth Ronaldinho
All the time wey I fit no be gym oh
Work N grind on my feet oh
Rather die than I quit oh
I go run my parol
Heavily till I blow
Poverty no be my own
Pass me my shayo
Light up my claro
Merriment with dem my own
We go dey chill on a steady
We go freeze dem
Solicit dem go beg we no go free dem
No retreat no surrender till we weep dem
Only filth here na poverty we sweep dem all
Away
Don't you ever come another day
Poverty away
Don't you ever come another day
So we say sapa away
Don't you ever come another day
Wahala away
Don't you ever come another day