Fine boys and fine girls ehh
Terry wia say make i tell una say na zero panic for this side ehh
We dey flex on a stead every day ehh
Take am easy naaa
Terry wia he say aza dey make you paste the teller
Yen on fire
King of japan shabi na tyler
How many people dem call
I no go wait make e reach my turn
Wear my boot make i match your door
If you no go talk oya make you comot
I dey see myself for japan
Terry wia no dey gree he no dey calm down
Many many money for the aza
Yen or USD for Canada
If you no dey speak japan oya start to comot
Terry and tyler say japan sure on God
Tell everybody make dem start to comport
Money dey come make nobody come dey rush
Money surplus japan dey cry for my head
If you call us carry your billing come no fear
Money surplus japan dey cry for my head
If you call us
Carry your billing come no fear
Clear
Who you know wey get personal Japan
For this benin city wey be say we dey
Terry wia
Tyler wia
And biggest Lamba
Say wahala
Bros even your biggest plug seff na we dey give dem account
Ogbeni see you fit go ask
See wahala
Our japan no get holiday brother steady nai we dey deliver
Ehh see
You wan dey whyne
From trekking na black benz we come dey drive
Ehh wahala
Which kind country we dey so
Boys dey steady dey bomb japan
You fit see me for house
But on a stead na osaka nai we dey
Ogbeni see the money too long my brother you no fit calculate na when you near nai you go fit relate