Na God dey do am
Na why I go praise am
Na God dey do am
Na why I dey praise am
Oh
Jehovah my God of wonders eh
Na hin dey do am eh,
If no be for your love
Me I no go dey here today
If no be for your help and grace
I for don die throway
As I look over my life I dey see
The many many ways you dey see me through
Na only your love dey for me
Your Miracle make me dey sing
When I enter the place today
Everything go work my way I pray
As I show up for here today
Baba God send your blessings my way
Cos the life wey I need, amen
Your mercy go give am to me, amen
Jehovah show up for me
And let the whole world see & believe
People just dey ask me say
Wetin dey make me smile
Wetin dey make me shine like dis
I tell dem say na God eh eh
Even when things dey hard
And the matter no dey better
I go still dey praise
Jehovah my God of wonders eh
He still dey on top my matter
And he go change am eh
God wey do am for me
He go do am for you
So praise am!