I'll be fine o I'll be fine
I have been through a lot o but I'll be fine
I'll be fine o I'll be fine
I know say I no get o, but I'll be fine
I Dey go far, I Dey reason
Some Dey think say I don Dey craze
But e get reason
Me, I need money, I need the raba o
If I no get money, wetin I gain, nothing I gain
You see that thing wey u like to dey think am
Clear that thing make your mind feel so lighter
Depression go make you more sadder
Stay happy and you grow very brighter
Baba God, make I dey migrate
Put all of my enemies to shame
Don't let sin take away my grace
Cause life go chop you like a python
I dey reason I Dey reason
Wetin dey make me reason no pass money
I dey busy, me no sleeping
Wetin dey make me no sleep, na the money
Cause if you get money, you be living thing
If you no get money, you are a non living thing
Buckle up brother make you stop sleeping
No dulling two, four, seven hustling
I'll be fine o I'll be fine
I have been through a lot o, but I'll be fine
I'll be fine o I'll be fine
I know say I no get o but I'll be fine
This life I know, I no dey empty
I go soon gara, me sef go get money
When nothing dey people look down on me
Wetin dey do u when you think of money
Some people dey doubt me I know
Cause blessings dey follow me all around
No sleeping, just jigging jigging
With a good vibe and a positive mind
You'll be fine o you'll be fine
We never get money yet o, but we go dey alright o
I'll be fine o you'll be fine too
Just keep pushing, you know, one love